BBNAIJA OR NAIJA - [ PIDGIN ENG]

avatar
(Edited)
My country people I greet una o, and all the hive family, I hail una. How una dey
Na matter of our country, Naija, I carry come jam una this coolele afternoon, I believe say nah only youth na him full this space, so nah una go fit reason watin I wan yan with una.

hive red logo.png

Blue White Modern Medical Presentation.png
Made with canva

As we know say our election don dey near small small, so many people don dey talk different kind things as per who them wan throway vote for, for the 2023 election and we don dey shout am since, even person wey no get ear sef don hear am say make all of us go get our PVC, especially us way be youths.

But one thing dey spoil my belle, e day vex me, e be like make I go consult the gods for our matter, Naija! we too dey dey easily distracted, we dey quick loose focus, this kind period wey be say nah opportunity to take change the narrative of this country nah him we con dey carried away with Big Brother naija.

Bbn.webp
Image Source

I take God beg una, I know say we like cruise, we like entertainment, but our future dey more important o, that 72days wey you wan use dey follow BBnaija abi any other program wey no go add value, abeg use am go collect your PVC, no sidon look, carry your body go the nearest INEC office wey dey near you, at the same time dey canvas for your candidate, no wait till dyeing minute.

I no talk say make una no watch una favorite programs o, but no let am carry all your attention and time mu, fear been catch the first two days wey dem start BBNaija, we no gree hear word again, twitter sef choke, suddenly everybody attention just shift to the show, na him make me use our own native English(pidgin) take dey beg una.

untitled.gif

Una own no go spoil o, abeg make we continue to dey educate our self, make we dey prepare our minds against the election and all the candidates dem, una see all those big big men ehn and politicians dem, dem no dey follow us watch all this shows, dem dey focused with their goals, that election dey their mind like pikin wey dey inside belle, If we youths loose guard small like this, dem go do us strong thing o.

No sidon look... go collect your PVC, no loose guard, shine ya eye well well!!!✌️
text16.png

FxX5caie56ynwsjysm2XuNozdMysq1YNDRbt9X9VeerNm1981Q9QbBM6epncuxLJhive naija.gif

hive red logo.png



0
0
0.000
12 comments
avatar

Congratulations @joebolite97! You have completed the following achievement on the Hive blockchain and have been rewarded with new badge(s):

You received more than 2750 upvotes.
Your next target is to reach 3000 upvotes.

You can view your badges on your board and compare yourself to others in the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Support the HiveBuzz project. Vote for our proposal!
0
0
0.000
avatar

Ahhh, my brother. Na true true you talk like this o🙂. I no de gbadun BBNaija sef 🙄and today ehn, my body tell me pepper😖 because I de under sun all because of PVC. E worth am. Na my future we de yan here!❤️
Thank you for posting in the HiveNaija Community!

0
0
0.000
avatar

Thank you @deraaa
Your face show your shoe shine
Thanks for stopping by
Your efforts to get your pvc no go go in vain
We will all live to experience a better country

0
0
0.000
avatar

I heard that this week is when the registration of PVC would close. So they only have this week left. I doubt if most of the other youths know. Their mind is already focused on Big Brother.

0
0
0.000
avatar

They have been distracted
Too bad

I just hope they extend it further

0
0
0.000
avatar

Okay here is another reminder I need to get my PVC....

0
0
0.000
avatar

Exactly...Nigerians are so easily distracted. I hope the majority of us don’t loose focus. Because if the wrong party wins, no one is ready for another 8 years of hell.

0
0
0.000