Happy New Week : Greetings to the people of HiveNaija

avatar

image.png

Good morning @HiveNaija this Akwa Ibom girl dey I hail oooo, Na your girl once again @evegrace. How your side na? and how your Sunday been go? Hope say you been waka go church go praise God? Me I go and I been dance wella. Nobody dance pass me oo, you need to see me my dancing step mehn, na legit.


Image Source

I just say make I come greet people for this community and yan una small matter wey dey ooo.

image.png

Hmmmmmmmm, una hear the torry wey I hear? I hear say Ngozi na girl ooo, you hear? Na wa ooooo, how dis thing take happen self? I come hear say, her boyfriend na boy oooo, e surprise me as e take surprise you self.

Imagine how that boy come talk say I be girl, I hate what I hate ooo. Make una help me warn am ooo 🤣

image.png

I just say make I come greet una small before I go do work. A happy new week to everyone wey dey for this community. My Naija people, make I come oo, my boss don dey look for me, abeg no tell am say una see me for here oo.

Abeg who dey for this community wey dey base for Akwa Ibom State make we do small amebo na.

Yak amendi (make I come)🏃



0
0
0.000
2 comments
avatar

my dear you are doing well...oooin
this ngozi be girl tori get as e be,
who won come settle de matter?
anyways, as regards the matter concerning hive naija member for akwa-ibom
we never too plenty but soon we go get more members around.
continue to dey enjoy our community.

0
0
0.000