Na me be this o; I don land for Hive Naija- my introduction

avatar

IMG_3613~2.JPG

Hello my handsome and beautiful Hiveans!!!
I greet una oh
I de happy like this ehh as I follow crash for here, me I no too Sabi to speak pidgin but the little wer I sabi talk I go talk make una hear 😊 because me I no de like carry last for something 😁

IMG_20191101_211213~2.jpg

Make I continue
My name na Fortune Etim aka @febbykeys. That name @febbykeys na to make people know say I de play piano.

I'm from a family of seven and me na the first son were my parent get. As the first son, I have so many responsibilities so I take advantage of every opportunity I have to hustle, learn and build relationships that will help me in the future.

IMG_20200531_092707_3~2.jpg

I be Nigerian oh, and I be confirmed awka Ibomite.

FB_IMG_15949370990073973.jpg

FB_IMG_15949371428063021.jpg

FB_IMG_15949371625259298.jpg

Me na handballer oh and I de play handball for my state "team Akwa United".I don win plenty medal for myself and for my state.

FB_IMG_15957090349575212.jpg

IMG_20200723_164038_524.jpg

DSC_0056~2.JPG

IMG_20200221_154811_195.jpg

IMG_20200307_143904.jpg

I de coach people for music aspect, singing, playing instruments, producing etc. As you see me so, I be person wer like better music and I get passion for music na I'm make me go learn as dem de take play piano and drums and with oluwah by my side, I don de play am very well for 5 years now.

FB_IMG_15957089249389712~3.jpg

I bin follow learn media work from my boss @remahrock. Na I'm teach me how to de snap, shoot video, and how to handle camera etc. And those things were I bin learn don help me today.

I get plenty talents wer Baba God don give me for this life wer we de so. I Sabi draw, I Sabi dance💃ehhh with this my slim bod.

DSC_0249.JPG

DSC_0225.JPG

FB_IMG_15949373645723327.jpg

I Sabi cook well well, and I Sabi chop and drink well well oh so ter I de go compete with people wer Sabi chop and drink and I go win 😀😀, me like this na comedian I be ehh. I fit make you laugh and if you no de careful you fit shit inside your trouser or skirt😁😁😁😁😋😋, me na camera man and I de do media work also and oyibo de call am "cinematograper" oh dah😁😁😀 hehe.

IMG_0379~2.JPG

My joy dey full as I don land jeke for here (hive naija) so my people dey here and I bin no sabi 🤔 it's a good thing to feel at home at least this awesome platform go make me and my fellow Nigerians express ourselves well. No be everytime we go de speak oyibo language "English" 😁. E de make us de too serious. Oluwah go bless the people were establish this amazing community.

DSC_0063~3.JPG

DSC_0065~3.JPG

I never finish oo 😚
Another were me like to do na to sow shoe. Me like this na oboki and no body teach me oh na me bin teach myself.

I de sing oh but my voice eeh 😂, I Sabi sing bass and terno well well. But I really love singing and I get hope say for this life, oluwah go hear my cry 😥😥 and see me through with better voice.

Me like this na person we de plain, I dey very simple but I no too like person were too talk like say d put battery for him mouth 👄.

IMG_20200328_143100_4~2.jpg

I bin person wer Sabi dress well well and I de like see person dress neat and decent. I de like package myself well even if I no get money like this but my packaging go confuse you😁😁😁.

No short cut to life oo, abi una know that one.

E Don finish oh my country people.

Oluwah go help us
As you don visit my blog so oluwah go bless you and give you plenty money. Amen, fire 🔥.

No forget oh, I still be @febbykeys



0
0
0.000
6 comments
avatar

Welcome to Hive Family Brother

I am inviting you to join our community here. A group that is dedicated to study the words of God through the teachings of brother Eli Soriano. Ask Brother Eli, the Bible will answer! Please check the link below
👇👇👇
https://peakd.com/c/hive-182074/created

0
0
0.000
avatar

Congratulations @febbykeys! You have completed the following achievement on the Hive blockchain and have been rewarded with new badge(s) :

You received more than 1000 upvotes. Your next target is to reach 1250 upvotes.

You can view your badges on your board And compare to others on the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

To support your work, I also upvoted your post!

Do not miss the last post from @hivebuzz:

HiveBuzz Ranking update - New key indicators
0
0
0.000
avatar

welcome to hive-ninja Fortune. DO make your way to our discord channel where you can get more information about our community

here is the link to our discord channel:
https://discord.gg/NvhgnG

0
0
0.000
avatar

Huge welcome to you bro...vlogging go sweet for you o as you go just dey talk dey go dey video yoursef....chai, na better talent.

E say e sabi chop well!!!😂😂😂😂😂confam!

Con join us for hive-naija discord channel, we plenty for there well well

0
0
0.000